058c1e6b472c217c5f436c7081cc8b03
Man wey naked no dey put hand for pocket
loose translation: You can’t do somethings if there are no certain conditions.

Chicken wey run way from borno go Ibadan go still end up inside  pot of soup
loose translation: You Can’t Run Away From Your Destiny

Today’s newspaper na tomorrow Suya wrap
loose translation: Keep calm! Nothing last  forever

Cow wey dey in a hurry to go America go come back as corn beef
loose translation: Just be patient. Let the game come to you. Don’t rush!

Akara and moin moin get the same parent na wetin dey pass tru make dem diffrent
loose translation: How you start doesn’t matter, what matters is how you finish.


To piss no hard but fowl no fit.
loose translation: It’s easy doesn’t mean everyone can do it.

NO matter how dark room wan be, man go still  locate woman breast.
loose translation; There is always a way when something matters much.

Custard na just pap wey jand
loose translation: Appearances are often misleading. – Looks are decieving


Wetin consign agbero with twitter handle or malu with face cap?
loose translation: Mind your business.

If life dey show you pepper my guy make pepper soup
loose translation: Make something good out of a bad experience

I get am before no be property
loose translation: Stop living in the past and start living in the present. 

If person too tey for party e go follow dem wash plate
loose translation: Don’t outstay your welcome

Rolling stone ofcourse na person push am now!
loose translation: There is always a reason for something

Craze no hard to form,na the trekking be wahala
loose translation: Easier said than done

No matter how hot your tempa be,e no fit  boil beans.
loose translation: Calm down,your temper won’t solve the problem

Every mallam with em own kettle, every aboki with em own radio.
loose translation: Every man for himself

You no need cutlery to chop slap
loose translation: You don’t need my translation to understand this lol :)

Opolo eye no be open eye
loose translation: Having Big eyes doesn’t make you civilised,lol

Leave matter for Mathias and Sabi for Sabinus.
loose translation: Let sleeping dog lie

Bring suya, bring suya….na cow body dey suffer am.
loose translation: Every action has a consequence

E go better na e go better, na im make ibo man still dey Kano
loose translation:When there is hope, there is Life.

my pple say na wen piss de finish naim e de stain cloth
Loose translation-It’s not over till it’s over


Escort me, Escort me, naim slave trade take start.
loose translation:Serious things sometimes start like joke

Na from play play dem dey form PLAYER
loose translation: Serious things sometimes start like joke

Pikin wen use agbada take stat guy go talk wetin e go wear wen e old.
loose translation:Slow and steady wins the race

The water wey dem use take make eba can never be recovered back.
loose translation: Don’t cry over spilt milk

Nearly no dey kill bird.
loose translation: It’s  either you have it or you don’t

Fly wey no get special adviser na im dey folow dead bodi enta grave
loose translation: Don’t stay ignorant

No matter how lizard dey do press up e no go get chest like aligator
loose translation:Be proud of who you are

The cassava today fit be gari tomorrow
loose translation: No condition is permanent

If mad man don beat ur mama before,if she see mechanic she go run…
loose translation: once beaten twice shy

Jollof Rice wey dey for d bottom of pot 2day go dey for top of cooler 2moro
loose translation: no condition is permanent

 Fowl wey dey carry for head no dey know say to waka na work.
loose translation: A dependant would not know the value of what he/she is enjoying.

Na from clap dance dey start.
loose translation: Big thing don’t  happen suddenly!

0 comments Blogger 0 Facebook

Post a Comment

 
Icepickkells
All Rights Reserved. © 2016.
Owner: Icepickkells
Designed By: Dealwap Technologies
Top